Up Gunners! The 1st Arsenal FC Pidgin Podcast (Friday, 20th Feb Edition) @tonydoe78


Up Gunners na de 1st of im kain Arsenal FC pidgin podcast show wey Tony Doe dey host with match preview, review, fan chant, music and dem dem!


COMMENTARY:

Arsenal go face Crystal Palace for Selhurst Park wey be tight stadium wey resemble Highbury.

We know say dis wan go be tough match but we no dey shake. Wilshere fit return from injury and e dey likely say Ospina na im go man post... na Buchi (@biggysmallzy) give us analysis as we collect small yans sef from Baba Wenger pre match conference.

In other news we NFF oga, Amaju Pinnick go visit Wenger on top building Nigerian football... I still neva understand wetin dat wan mean.

We take we new chant wey me and Ochuko concoct for backyard as we we dey wash cloth (If You Love The Arsenal) take finish de show! Up Gunners!!!

Enjoy!!!





If u be Arsenal Fan and you wan participate for de show e no hard just take ya phone record ya expectation for Arsenal this season, talk ya name and twitter handle join send am to upgunnerspodcast@gmail.com, broadkasthussle@gmail.com

0 Comment "Up Gunners! The 1st Arsenal FC Pidgin Podcast (Friday, 20th Feb Edition) @tonydoe78"

Post a Comment

Thank You For Reading....Your Comments Are Always Welcome!

Thank you for your comments