Up Gunners! The 1st Arsenal FC Pidgin Podcast (Friday 13th March Edition) @tonydoe78


Up Gunners na de 1st of im kain Arsenal FC pidgin podcast show wey Tony Doe dey host with match preview, review, fan chant, music and dem dem!

COMMENTARY

Dem no believe in miracles like we... dem been even gada for up, dey circulate like vulture wey wan feast on top dead bodi but as God pass dem, the tactics work and de boys been rise to de occasion as Arsenal defeat Manchester United 2-1 for dem own backyard!!!

No be God?

Dat wan now mean say Arsenal don qualify for the semi final of the FA Cup.

"Que sera sera... 
We are going to Wembley..."

Inside dis podcast una go hear sweet yans from 2 of de finest goonerettes wey we get @radio_activist, & @chidiberri (more go feature no worry), plus expert analysis from @biggysmallzy as usual!

As for Chelsea fans, take heart even though i still chook finger for una eye sha!!!

Enjoy!!!


Click below, download, enjoy and share!




If u be Arsenal Fan and you wan participate for de show e no hard just take ya phone record ya expectation for Arsenal this season, talk ya name and twitter handle join send am to upgunnerspodcast@gmail.com, broadkasthussle@gmail.com


0 Comment "Up Gunners! The 1st Arsenal FC Pidgin Podcast (Friday 13th March Edition) @tonydoe78"

Post a Comment

Thank You For Reading....Your Comments Are Always Welcome!

Thank you for your comments