Up Gunners! The 1st Arsenal FC Pidgin Podcast (Friday 27th Feb Edition)



Up Gunners na de 1st of im kain Arsenal FC pidgin podcast show wey Tony Doe dey host with match preview, review, fan chant, music and dem dem!


COMMENTARY: 
Dem say de ting wey no fit kill you go turn you to Hulk Hogan!!!

Eh? Who talk am?

I no know but e mata?

De ting be say we lose to Monaco with a very shambolic display according to Dede Claude but I go leave de mata of post game analysis to my able bodied cohort and analyst Buchy aka @BiggySmallzy.

Una go still hear from Claude, TY and Baba Wenger.

We dey 3rd place for Premeir League table, we get opportunity dis weekend to consolidate am as we go face Everton for we house. Summary and more inside de package!

Click,download, enjoy and share! 


Up Gunners!!!

If u be Arsenal Fan and you wan participate for de show e no hard just take ya phone record ya expectation for Arsenal this season, talk ya name and twitter handle join send am to upgunnerspodcast@gmail.com, broadkasthussle@gmail.com

0 Comment "Up Gunners! The 1st Arsenal FC Pidgin Podcast (Friday 27th Feb Edition) "

Post a Comment

Thank You For Reading....Your Comments Are Always Welcome!

Thank you for your comments