Up Gunners! The 1st Arsenal FC Pidgin Podcast (Monday 20th January Edition) @tonydoe78


Up Gunners na de 1st of im kain Arsenal FC pidgin podcast show wey Tony Doe dey host with match preview, review, fan chant, music and dem dem!
Up Gunners!!!

Commentary:

Na 2 - 0 e take finish for Etihad as Cazorla and Giroud score wan each to give Arsenal 3 points away against current league champions dem Manchester City!!!

See as Arsenal pack sand full de mouth of dem bad bele people... before de match Baba Wenger been talk say de poor results from before no go affect de result of dis match.

Ayuwa!

We go Etihad, knock for door, still use leg demolish de door pack we loot cari go back Emirates!!!

Naija Gooner dem Chuks Asoegwu and BiggySmallzy na dem anahilate... sorry analyse de match for we!!!

Download! Listen! Laugh and Share!


Up Gunners!!!

If u be Arsenal Fan and you wan participate for de show e no hard just take ya phone record ya expectation for Arsenal this season, talk ya name and twitter handle join send am to upgunnerspodcast@gmail.com, broadkasthussle@gmail.com

0 Comment "Up Gunners! The 1st Arsenal FC Pidgin Podcast (Monday 20th January Edition) @tonydoe78"

Post a Comment

Thank You For Reading....Your Comments Are Always Welcome!

Thank you for your comments